Wednesday, 23 January 2013
Politics palava
Una gudevening oooo,na wa o...see as all dis politicians(legalized thieves) don dy make der intentions knw....one say him name na BATO,for him banner he dy quote bible and i knw say for sure say he no dy go church...anoda say he name na sugarry samson...only him face for d banner don make dem knw say na thief he wan come thief....d one wer pain me pass...na d shemale wer wan con b oleh SUG pres....i here say na she b word of life campus fellowship sistas leader.....her name na harriet.....i no knw wetin con push m say na president she wan run for ...anoda mumu wer wan thief too wer dy 300l say him name na mathias.....he neva see he CGPA...he say na SUG pres he wan run for he feel say to merge politics and akada na beans...no worry hand go touch all of una......
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment