Friday, 25 January 2013
PREDEGREE EXAMS
dis na to inform una say predegree exam na tomoro ooooo.....wetin dy pain me pass for dis exam b say dem knw say dem go take all d students ooo but dem just wan waste paper and ink...anyway i dy wish dem success for d program..but as we knw many are called,but few are chosen...
THE RECENT RENOVATION GOING ON IN CAMPUS
so hw wish no be accreditation team wer come last year,dem, for no renovate school.......at last all os engineering lecturers,we dy use toilet as office don move enta one room and all d HODs wer dy one room don move enta room and palour...D one wer pain pass na law dean(tom) wer d use belle do signboard,he go dy jump for everywer anyhw,i no knw wetin make dem give dean,he for dy advertise bobozzi.....Also one lecturer for engineering wer e name na kingsley,na him dy take material science don buy camry...so he trekking days ar ova...and thank God for engr efenedo life,he don buy new polo,new shoe and new trousers...at least he renovate himsef frm all dos he polo wer he dy wear wer b lyk say dem dy us filter akamu....Also thanking God for prof giasoko for changing all dos bedsheets wer he dy wear before to coats mayb by next yr he go renovate to suites,.....
COSTOMI EXPANDS SHOP
Una gudevening oooo...hw una dy enjoy d semester na.....wonders dy happen...as dis present 200l engineering students and new intakes na costomi vex start to expand he shop....but he forget say after 1st semester dem go calm down con serious for der books,so by den he no go get customers
Wednesday, 23 January 2013
RESULTS WAHALA
na wa ooooo...see as tension full everywer as departments don dy paste results....d wan wer funny pass na miss oleh(chinelo) campus and her friends....dem dy happy and dem dy good mood as dem dy go check....as dem com out der eyes con dy red...dem com turn to by force stammerers...dat one mean say..........fill in d blank spaces....anoda one na all dos 300l wer just see der 200l results...all der heads con cam down...many con repent,see as fellowships dy get ova flow nw....bcos many don resolve say na only God fit help dem nw...
Politics palava
Una gudevening oooo,na wa o...see as all dis politicians(legalized thieves) don dy make der intentions knw....one say him name na BATO,for him banner he dy quote bible and i knw say for sure say he no dy go church...anoda say he name na sugarry samson...only him face for d banner don make dem knw say na thief he wan come thief....d one wer pain me pass...na d shemale wer wan con b oleh SUG pres....i here say na she b word of life campus fellowship sistas leader.....her name na harriet.....i no knw wetin con push m say na president she wan run for ...anoda mumu wer wan thief too wer dy 300l say him name na mathias.....he neva see he CGPA...he say na SUG pres he wan run for he feel say to merge politics and akada na beans...no worry hand go touch all of una......
Thursday, 17 January 2013
APOLOGIES
Abeg make una no vex,na because of some technical difficulties na make we neva dy bring una notices and news on campus......and dis na to info una say we don come back fully......thanks for una understanding........
Monday, 14 January 2013
fresher days
As i dey see all dese small jjcs dey try locate their clearance venue i dey remember my own mumu days...chai!!!...i don big finish o!
Thursday, 10 January 2013
Man die for Eboh Hotel
Wonders No Go End For Oleh Oooooo ,dis Morning Our Crew Gada From Eboh Hotel Say One Man ,wer Just Buy One New ashes BMW Motor,con Dy Cruise Around Town,just Say Make He Spend D Nyt For Eboh Hotel.so as he wake up dis morning say make he comot,he wan con open d door of d motor na he collapse for ground........but report wer we gada dy say na hernia kill ...... but imagine person wer just buy motor,neva drive am for a day ,just collapse as he wan open am,na wa oooo,,,,,,,,una sure say evil hand no dy so?
Wednesday, 9 January 2013
ALERT.......
Dis na to inform una say engineering screening dy start tomoro by 10:00 am and law don start der own today...abeg make una inform una pple wer get admission,weda legally or illegally(runs) say screening don start ooooo........and una wer b old students(boys) wer neva get babe dis na d tym be d tym to catch dem young oooo..hurry up as offer last ......
FYB....NO BE BEANS OOOOO...
To enter final year no b beans oooooo....see as all dis final year for law don dy hulk der head wit der bedsheet coat dy go dean class....but dean no go get sense for once....he no go allow dem rest small...na so dem do am(dean) na he graduate..mayb d fybs dy enjoy am too sha,as he dy shark dem
Tuesday, 8 January 2013
HOUSE WAHALA FOR OLEH
Una gudmorning ooooo....na wa o,see wetin accommodation dy cause for oleh...as early as 5:30am...freshers don enter street dy find house.....even some don resolve to hire caravan and stores to stay...na wa o.....d one wer pain me pass na d one wer find house go aluta motuary....
WELCOME TO SUFFER
On behalf of myself and d whole aproko crew i say welecome to all d people dem wen delsu give admission(even though plenty of dem na small small pikin) and even dose wen collect d admissiom by force(runs)...UNA WELCOME!!!
Subscribe to:
Comments (Atom)