aproko247
Friday, 25 January 2013
PREDEGREE EXAMS
dis na to inform una say predegree exam na tomoro ooooo.....wetin dy pain me pass for dis exam b say dem knw say dem go take all d students ooo but dem just wan waste paper and ink...anyway i dy wish dem success for d program..but as we knw many are called,but few are chosen...
THE RECENT RENOVATION GOING ON IN CAMPUS
so hw wish no be accreditation team wer come last year,dem, for no renovate school.......at last all os engineering lecturers,we dy use toilet as office don move enta one room and all d HODs wer dy one room don move enta room and palour...D one wer pain pass na law dean(tom) wer d use belle do signboard,he go dy jump for everywer anyhw,i no knw wetin make dem give dean,he for dy advertise bobozzi.....Also one lecturer for engineering wer e name na kingsley,na him dy take material science don buy camry...so he trekking days ar ova...and thank God for engr efenedo life,he don buy new polo,new shoe and new trousers...at least he renovate himsef frm all dos he polo wer he dy wear wer b lyk say dem dy us filter akamu....Also thanking God for prof giasoko for changing all dos bedsheets wer he dy wear before to coats mayb by next yr he go renovate to suites,.....
COSTOMI EXPANDS SHOP
Una gudevening oooo...hw una dy enjoy d semester na.....wonders dy happen...as dis present 200l engineering students and new intakes na costomi vex start to expand he shop....but he forget say after 1st semester dem go calm down con serious for der books,so by den he no go get customers
Wednesday, 23 January 2013
RESULTS WAHALA
na wa ooooo...see as tension full everywer as departments don dy paste results....d wan wer funny pass na miss oleh(chinelo) campus and her friends....dem dy happy and dem dy good mood as dem dy go check....as dem com out der eyes con dy red...dem com turn to by force stammerers...dat one mean say..........fill in d blank spaces....anoda one na all dos 300l wer just see der 200l results...all der heads con cam down...many con repent,see as fellowships dy get ova flow nw....bcos many don resolve say na only God fit help dem nw...
Politics palava
Una gudevening oooo,na wa o...see as all dis politicians(legalized thieves) don dy make der intentions knw....one say him name na BATO,for him banner he dy quote bible and i knw say for sure say he no dy go church...anoda say he name na sugarry samson...only him face for d banner don make dem knw say na thief he wan come thief....d one wer pain me pass...na d shemale wer wan con b oleh SUG pres....i here say na she b word of life campus fellowship sistas leader.....her name na harriet.....i no knw wetin con push m say na president she wan run for ...anoda mumu wer wan thief too wer dy 300l say him name na mathias.....he neva see he CGPA...he say na SUG pres he wan run for he feel say to merge politics and akada na beans...no worry hand go touch all of una......
Thursday, 17 January 2013
APOLOGIES
Abeg make una no vex,na because of some technical difficulties na make we neva dy bring una notices and news on campus......and dis na to info una say we don come back fully......thanks for una understanding........
Monday, 14 January 2013
fresher days
As i dey see all dese small jjcs dey try locate their clearance venue i dey remember my own mumu days...chai!!!...i don big finish o!
Subscribe to:
Comments (Atom)